Jump to content

Ngozi Okonjo-Iweala

From Wikipedia
Ngozi Okonjo-Iweala
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Nem for lokal langwejNgozi Okonjo-Iweala Chenj-am
Fest nemNgozi Chenj-am
Famili nemOkonjo, Iweala Chenj-am
Wen dem bon am13 June 1954 Chenj-am
Ples wey dem bon amOgwashi-Uku Chenj-am
PapaChukuka Okonjo Chenj-am
PikinUzodinma Iweala Chenj-am
Fest langwejIgbo langwej Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Igbo langwej, Naijá langwej Chenj-am
Ancestral homeOgwashi-Uku Chenj-am
Wok wey e dey dudiplomat, economist, politician, minister Chenj-am
Pat of wok wey e put mindeconomics, banking industry, bank management, money management, finance ministry Chenj-am
Wu e dey wok forWorld Bank Group Chenj-am
Post wey e deyMinister of Finance of Nigeria, Minister of Foreign Affairs, managing director, Minister of Finance of Nigeria, Director-General of the World Trade Organization Chenj-am
Wie e go skulHarvard University, Massachusetts Institute of Technology, MIT School of Architecture and Planning, International School Ibadan Chenj-am
Affiliation stringFederal Ministry of Finance, GAVI Alliance, Gavi, the Vaccine Alliance, World Trade Organization (WTO) Chenj-am
Party wey e dey for politisPeoples Democratic Party Chenj-am
E pipulIgbo pipul Chenj-am
Memba ofGlobal Financial Integrity, World Resources Institute, American Academy of Arts and Sciences Chenj-am
Official websitehttp://ngoziokonjoiweala.com/ Chenj-am

Ngozi Okonjo-Iweala (Dem bon am on 13 June 1954) na Naija-American ekonomist, wey don dey sarf as Direkto-General of di World Trade Organization sins March 2021. Na shi bi di fest Wuman an Afrika pesin wey go leed di World Trade Organization as Direkto General. Shi bi boards of: Famine, Standard Chartered Bank, MINDS: Mandela Institute for Development Studies, Carnegie Endowment for International Peace, Georgetown Institute for Wumen, Peace an Sekuriti, One Campaign, GAVI: Global Alliance for Vaccines Immunization, Rockefeller Foundation, R4D: Results for Development, ARC: Afrikan Risk Capacity an Earthshot prize wit some oda ones. Shi don sidon for di Twitter Board of Direktos, kon komot in February, 2021 wen dem giv am Direkto-General of di World Trade Organization. Okonjo-Iweala sarfs Brookings Institute wit di Afrika Growth Intiative in dia Global Economy an Development program. Na shi bi di Commissional Emeritus an Co-chair of Global Commission on di Economy an Climate. For di World Bank, shi wok for 25 years as divelopmet economist; shi rish Managing Direkto stej for Operations fom 2007 rish 2011. Na Okonjo-Iweala bi di fest Naija wuman wey go sarf two times as Finance Minister of Nigeria; fest time na onda President Olusegun Obasanjo fom 2003 rish 2006; an sekon, na onda President Goodluck Jonathan fom 2011 rish 2015. Shi don sarf as Minister for Foreign Affairs of Nigeria bifor. In 2005, Euromoney nem am Global Finance Minister of di Year.

Hau e tek stat life an skul

Dem bon Okonjo-Iweala in Ogwashi-Ukwu, Delta State, Nigeria, wia im papa, Professor Chukwuka Okonjo, bi di obi (king) of di Obahai Royal famili of Ogwashi-Ukwu wey dey Naija. Okonjo-Iweala go Queen's School, Enugu; St Anne's School, Molete, Ibadan, Oyo State; an di International School Ibadan. Shi go US in 1973 to stodi for Havard University. Shi get masters digre in City Planning in 1978 an PhD in regional economics an development in 1981 fom di Massachusetts Institute of Technology wit Thesis Credit Policy, an Nigeria finance policy, an Nigeria's agricultural development. Shi get internashonal Awod fom di American Association of University Women (AAUW).

Im wok

World Bank

Okonjo-Iweala don wok for 25 years for World Bank wey dey Washington, D.C, na fom developmet ekonomist shi tek rish sekond Posishon of Managing Direkto, Operations. Wen shi bi Managing Direkto, shi hep World Bank monito $81 billon Moni wey dem plan to tek wok for Afrika, South Asia, Europe, an Central Asia. Okonjo-Iweala wok wit Wod Bank to tek kontris wey no tu dey ci moni for Afrika.

Wia dem gada di Tori

1.