Jump to content

Ngozi Okonjo-Iweala

From Wikipedia

Ngozi Okonjo-Iweala (Dem bon am on 13 June 1954) na Naija-American ekonomist, wey don dey sarf as Direkto-General of di World Trade Organization sins March 2021. Na shi bi di fest Wuman an Afrika pesin wey go leed di World Trade Organization as Direkto General. Shi bi boards of: Famine, Standard Chartered Bank, MINDS: Mandela Institute for Development Studies, Carnegie Endowment for International Peace, Georgetown Institute for Wumen, Peace an Sekuriti, One Campaign, GAVI: Global Alliance for Vaccines Immunization, Rockefeller Foundation, R4D: Results for Development, ARC: Afrikan Risk Capacity an Earthshot prize wit some oda ones. Shi don sidon on di Twitter Board of Direktos, kon komot in February, 2021 wen dem giv am Direkto-General of di World Trade Organization. Okonjo-Iweala sarfs Brookings Institute wit di Afrika Growth Intiative in dia Global Economy an Development program. Na shi bi di Commissional Emeritus an Co-chair of Global Commission on di Economy an Climate. For di World Bank, shi wok for 25 years as divelopmet economist; shi rish Managing Direkto stej for Operations fom 2007 rish 2011. Na Okonjo-Iweala bi di fest Naija wuman wey go sarf two times as Finance Minister of Nigeria; fest time na onda President Olusegun Obasanjo fom 2003 rish 2006; an sekon, d na onda President Goodluck Jonathan fom 2011 rish 2015. Shi don sarf as Minister for Foreign Affairs of Nigeria bifor. In 2005, Euromoney nem am Global Finance Minister r of di Year.

Hau e tek stat life an skul

Dem bon Okonjo-Iweala in Ogwashi-Ukwu, Delta State, Nigeria, wia im papa, Professor Chukwuka Okonjo, bi di obi (king) of di Obahai Royal famili of Ogwashi-Ukwu wey dey Naija. Okonjo-Iweala go Queen's School, Enugu; St Anne's School, Molete, Ibadan, Oyo State; an di International School Ibadan. Shi go US in 1973 to stodi for Havard University. Shi get masters digre in City Planning in 1978 an PhD in regional economics an development in 1981 fom di Massachusetts Institute of Technology wit Thesis Credit Policy, an Nigeria finance policy, an Nigeria's agricultural development. Shi get internashonal Awod fom di American Association of University Women (AAUW) .

Im wok

World Bank

Okonjo-Iweala don wok for 25 years for World Bank wey dey Washington, D.C, na fom developmet ekonomist shi tek rish sekond Posishon of Managing Direkto, Operations. Wen shi bi Managing Direkto, shi hep World Bank monito $81 billon Moni wey dem plan to tek wok for Afrika, South Asia, Europe, an Central Asia. Okonjo-Iweala wok wit Wod Bank to tek kontris wey no tu dey ci moni for Afrika

Wia dem gada di Tori

1.